Nollywood actress Tonto Dikeh, husband Churchill, don dey look for Tonto and im son King Andre, say mek public help fined dem, after break up.
The Husband and wife, wey dey leave happy life before, nayim don enter serious marriage wahala.
Approko yarn say, Churchill dey touchlight another woman, wey be im PA, for back yard.
We don hear many tori ontop this matter, but the thing be say, Tonto don block every where, so her husband Churchill, no go fit reach her and their pikin Andre.
As he be, Churchill wey won celebrate, im pikin, birthday, for mek sense way, no fit see the pikin again as Tonto, no go allow am see the pikin.
Read also: “Daddy is still trying to get exclusive access to you” Tonto Dikeh husband tell im pikin, after marriage break up with Tonto.
But Churchill celebrate the pikin Birthday, ontop social media, im post empty chair, wey king fit sit down put, as im yarn ontop the birthday matter.
Churchill cry say mek public, help am look for im pikin ooo, Tonto no dey gree pick call, even nanny.
Read wetin im yarn
"Would apprecite if you can join me look for them. i don't have access to her (Tonto Dikeh) and the nanny doesn't pick up..."
ConversionConversion EmoticonEmoticon