Dem don finally release Audu Maikori, wey be chocolate City boss, wey dem arrest after im yarn, tori wey no be true, ontop the kill kill wey shelle for Southarn Kaduna.
Nigerian Police Force inside Lagos DSS, nayim arrest
Audu Maikori, wey be record label chocolate City Oga, for yesterday February 17, con carry am from Lagos enter Abuja, after im yarn about the southern Kaduna kill kill for twitter.
Audu, been post one news, wey no be true for twitter say, dem kill some student, because of the kill kill wey dey shelle for Kaduna.
The tweet bring many mouth inside the matter, as many Naija chuck mouth.
But, dem con later fine out say, nothing like that happen, as dem contact the tertiary institution, wey yarn say no student die.
But
Audu apologize later, say na approko im hear.
Today, tweet go up and down, say mek dem release, Audu #FreeAudu.
And now
Audu, don come out from DSS hand. after some top notch people like,
Femi Fani Kayode and
Oby Ezekwesili chuck mouth inside the matter.
Read wetin im been post, before dem arrest am
Godsgift Ajomafuwe is an handsome young smart passionate optimistic individual, a social media Manager, a content developer, Photographer, leader who has worked and voluntered for alot of organization.he belives our life is what we make of it.
Related Post
Baba Oyoyo see as youths carry customized Cow to celebrate Buhari.As Presido Muhammadu Buhari don come back from im 51 day medical vacation inside UK, Youths don ent
Reuben Abati: The Nnamdi Kanu Phenomenon.The most discussed subject in Nigeria today is what is called “restructuring” and indeed so popular
Ex-AIT Chairman, Raymond Dokpesi and former Labor party chairman, Dan Iwuanyanwu, don open new party, APDAFormer Chairman for AIT and chief for PDP, Raymond Dokpesi and former Labor party chairman, Dan Any
Wetin you think say "N'abania" Flavour dey yarn with im two pikin? , oya check out the picture."N'abania" Flavour, share picture of im self and im two fine pikin, Gabrielle and Sofia, for I
ConversionConversion EmoticonEmoticon