Pretty mike don come out with another system, who go arrest am this time???.
He never too tey, wey Governor Ambode order the arrest of One club owner, wey name na Pretty mike, for say, im tie chain for two girls neck, like dog enter party.
But im later apologize sha, as Naija run insult ontop im head, plus Ambode arrest.
Now Pretty mike don come with another one.
This time, Pretty mike wey approko carry say, nayim dey date Baba for bleaching, Okuneye Idris Olanrewaju aka Bobrisky, don dey waka about, dey drink from feeding bottle.
See Pictures.
ConversionConversion EmoticonEmoticon