"Wetin concern una with church matter?" Fani-kayode
Femi Fani-Kayode, wey chuck mouth ontop the ritirement, wey shelle ontop the general overseer of The Redeemed Christian Church of God,
Enoch Adeboye, yan say Nigerian government just wan attack church inside Naija.
As the matter be, the former minister, yan this one, after im ear hear say, the federal governmemt release new Financial Reporting Council of Nigeria (FRCN) law, wey go chuck eye inside church matter and church pastors inside Naija.
Dem write for the new law say, na 20 years general overseers for chuch go dey office or wen im reach 70 year.
The first G.O to obey this law, na Pastor
Enoch Adeboye.
Still ontop the matter, last week the RCCG bring one statement say Enoch Adeboye don retire as RCCG general overseer.
Read also:
Pastor E.A Adeboye don retire as the RCCG General Overseer, see the new G.O.
The statement still yan say Pastor
Joseph Obayemi, go be the new National Overseer for the church, while Adeboye go be the general overseer for obodo the world.
Fani-Kayode for twitter, dey para say this law wey the government put, na to attack the church wey dey inside Naija.
Im con dey ask the government say wetin concern dem with church matter.
Godsgift Ajomafuwe is an handsome young smart passionate optimistic individual, a social media Manager, a content developer, Photographer, leader who has worked and voluntered for alot of organization.he belives our life is what we make of it.
Related Post
FG don announce June 26 and 27 as public holiday to mark Eid-el-Fitr.The Federal Government don yarn say Monday, June 26 and Tuesday, June 27 go be Public Holiday as to
See Photo: IG of Police Idris Ibrahim pay Governor Ambode August visit as im enter Lagos House, Ikeja, on Thursday.Inspector General of Police, Mr. Idris Ibrahim waka enter Lagos House, Ikeja, on Thursday, August 3
Vice presido, Yemi Osinbajo don beg NASS say mek dem approve $1.49bn loan for 10 states inside Naija.Vice Presido, Yemi Osinbajo don write letter give the National Assembly, dey tell dem say, may dem
"Presido Buhari go enter Naija before June 11" ex Abia Governor Izor Kalu yarn.Ex-Abia State Governor, wey be Orji Uzor Kalu, on Sunday, don yarn say Presido Buhari health don de
ConversionConversion EmoticonEmoticon