UNIJOS prospone Exam After serious Fire gbege wey scatter school property.



On the 8th of October 2016 one serious fire gbege happon for the university of Jos inside the Library Complex, Naraguta Campus.

UNIJOS Fire

As the matter be, this fire gbege shele for the main Library complex, the Faculty of social science and some Departments inside the Faculty of Management Sciences.

Monday M. Denjem wey be the Registrar for the school yarn for one statement say dey go Pros pone the 2015/2016 session first semester Examination wey suppose to take place for on Monday today the 10th of October.

The statement still yarn say make the student calm down and make dey continue dey do wetin dem suppose to do, say dem dey handle the matter wella
So today the senate chambers of the school go enter meeting yarn ontop this matter to see the way foeward.

The Vice-Chancellor,wey be Prof. Sebastian Maimako tell news people for on sunday after im see as the fire take bring evry every down say  the fire start for about 6:30pm

Read wetin im talk..         
 “On the fourth floor, which was completely razed down, we have the departments of Psychology, Political Science, Economics and office of Dean of Management sciences,”
See Pics
 


Previous
Next Post »

Featured Video