Eh EH Portugal don win France for their own house
As Portugal don be best loser, dey don fight to get the European glory
Portugal start the match with 4-4-2 formation with C. Ronaldo and Nani wey dey front. But he no too tey before Ronaldo get knee injury
As dey start the second half Quaresma con replace Ronaldo, wey don get injury.
But as dey fight reach for second half, dey still end up for 0-0
Dey con give dem extral time
Ronaldo con comout o. dey tell im team say mek dey mek sure say dey carry the cup reach house
Eder wey dey put for substitute nayim con score the goal for the extral time
Befor dey know Portugal don win France o 1-0 so dey con turn Europe champion.
Na belle just dey sweet Ronaldo while some na tears of joy dey fall like waterfall from their eye while France dey just sit down dey look like lukumon
ConversionConversion EmoticonEmoticon