FG don extend Public Holiday to July 7: Eid al-Fitr



Una know say dem talk befor say the Holiday go dey from Tuesday and Wednesday but FG don carryam till Thursday July 7.


Federal Government don talk say Wednesday, July 6, and Thursday, July 7 go be public Holiday as dey won celebrate Eid al-Fitr sake of the moon don wakajugbo comout.

Lt.-Gen. Abdulrahman Dambazau (rtd), wey be the Minister of Interior talk this one for Tuesday today, for one statement wey Bassey Akpanyung wey be the Secretary for inside the same ministry sign.

dem say dey need to Extendam, sake of the Presido General, Nigerian Supreme Council for Islamic Affairs, Alhaji Sa’ad Abubakar III say the Ramandan fast go continue on Tuesday sake of dey no dey see the moon again.

The minister still say mek Nigerians use this period as time wey dey go mek Unity and peace dey for the country. im still say mek every body supoport the buhari govnment

Previous
Next Post »

Featured Video