Troops kill terrorist for borno



The Acting Director Army Public Relations,
Colonel Sani Kukasheka Usman, for one statement wyn him get from Nigerian Army official website, say  " Umar Mustapha wyn be Boko Haram terrorist who claime say him come from Sabsawa, say dem do handam over to the Brigade Headquarters. So dey go interrogatetam wella.

Usman still say the troops don continue still dey look for oda Boko Haram terrorists for inside Sambisa forest.

The Army spokesman say "as the matter dey go, say this morning, troops of 112 Battalion wyn go patrol from Mafa to Dikwa say Boko Haram gbege dem for Ajiri village. But dem try gbege dem back but one soldier die. While 3 soldiers injure well well. One of the civilian JTF wyn follow the patrol team  injure self.

"Him say the team kill 8 Boko Haram terrorists con collect arms and ammunitions for the place wyn the gbege for happon.  Wetin, dey collect na, 1 Rocket Propel Grenade (RPG), AK-47 Rifles, 2 Rocket Propel Grenade bomb, 3 AK-47 Rifle Magazine and 120 rounds of 7.62mm ammunition."

Him still say "The troops collect 3 Improvised Explosive
"The body of the late soldier and the once wyn  injure say dem don carry dem go 7 Division Medical Services and Hospital, Maiduguri."

Previous
Next Post »

Featured Video