Governor go pay workers half month salary for on Monday



Dey say the governor don give order on saturday june 11, according to statement wen him chief Press Secretary, Daniel Iworiso-Markson give

Dickson,don give order say mek dem pay workers their salary but people wey him give the money, never give workers.

him con warn say if they no pay the workers wey dem dey hole salary for five month, say befor Monday  him go take disciplinary action against the erring officers.
Dey say Dickson don dey ask say mek dem givam quick reason why dey never pay and why dem dey delay.
him con commend the workers for the patience wen dey get,con still say him administration dey concern about their welfare.

The workers don call off their strike after dem do three days protest as dem never pay dem their five months salaries.
Dey even say dem don accept government offer to pay 50% of their salaries, wen go start from February.

Previous
Next Post »

Featured Video