Na wa o no be small thing dey shele for inside this our Naija, as 15 people die for serious accident
This terrible accident shele for Fidiwo-Ajebo, Ogun State for lagos ibadan Expressway, yesterday
Fiteen people die,14 passengers and one danfo driver as one , fuel tanker and danfo jam each other
Dey say the thing wey cause this accident na wey the driver of the truck wey carry fuel dey go ibadan won con overtake anoda truck. The driver con loss control of the truck con carry himself go jam the danfo moto wey dey come from im from.
Police o, FRSC O, Ogun State Traffic Compliance and Enforcement Agency (TRACE) o, run go there dey try to save people wey get the accident as the moto don scatter finish
Ogun state sector cammander for FRSC wey name na Adetunji Adegoke tell the nation say na 15 persins – six females and nine males die ontop the matter and one person injure.
Adetunji Adegoke say people too dey drive anyhow, dem dey drive like say heaven door won close and na this kind of driving mek dem die so. him say dey carry the one wey injure go Olabisi Onabanjo University Teaching Hospital (OOUTH), Sagamu. the once wey die go, FOS Mortuary, Ipara, near Sagamu.
Him dey drag ear say mek we dey follow wetin road traffic peple dem talk and say overtaking no good and mek we dey check our tire befor we waka enter road.
ConversionConversion EmoticonEmoticon