The Commissioner for Agriculture and Forestry for Kaduna state, Manzo Daniel today don say the state government don declare state of emergency on top tomato because of tomato blight wen clear out about 80percent of tomato farms for the state. Manzo talk this one wen him dey for one press briefing, wen go mark one year wen the administration don enter office
"Dey say the tomato blight na won insect wen dem dey call leafminer, wen scientists dey call tuta absoluta. Wetin the insect dey do na to eat the tomato leaves and soft part. Dey still say this kind tin happen last year but he no bad reach the one wen happen now and dey no write am for book. And say wen dey come office dey no hear anything about the wahala, until mouth no fit close again. Dey don send some official wen the matter concern well wel go Kenya make dey go fine water pour for the fire.
Dey say the matter eh serious sote dey say make dey declare state of emergency for the tomato.
The matter con still serious sote, Dangote Tomato factory for Kano close because of the wahala and no tomato to take produce.
Mazo still say over 200 farmer don loss money wen reach N1billion becuase of the disease wen this insect carry com. Dey don dey sell one basket of tomato for N42, 000.
ConversionConversion EmoticonEmoticon