Presido Buhari don set to start work tomorrow Monday, March 13.



As Buhari don enter Naija, after im don spend 51 days for medical vacation for UK, im go start work tomorrow, March 13.

Buhari set to resume office this Monday, March 13

According to Guardian, presidency dem, don yarn say, Buhari no yarn, ontop the matter say, may vice presido Yemi Osinbajo, continue to act as presido for many weeks o, say Presido Buhari strong gidigba.

Presido tell the Federal Executive Council and military chiefs, for the First Lady Conference Room, inside presidential villa on Friday Morning say, im come for the weekend so Yemi Osinbajo go continue dey act, while im go continue dey rest, e.i im go rest before monday.

Read wetim im yarn..

“I am feeling much better now. There may however be need for further follow up within some weeks. I deliberately came back towards the weekend, so that the Vice President will continue and I will continue to rest".

Special Adviser to the Presido ontop media and publicity matter,  Femi Adesina,  tweet for im handle, for on Friday afternoon, ‎say Presido, go carry letter enter the National Assembly, so that, im go start work wella, according to Naija law.

Previous
Next Post »

Featured Video