Court don sentence former Adamawa state governor to 5 years inside prison.



The immediate past governor for Adamawa state,wey be James Ngilari nayim court sentenced to 5 years inside prison, for say im give contract of N167 million, to buy 25 moto for im commissioners. and no follow the state law, before im buy the moto dem.

 

The Economic and Financial Crimes Commission (EFCC), nayim carry the former governor, and two others of im members,  Andrew Welye (Secretary to the State Government) and Sunday Lamurde (Commissioner for Finance), enter court

But the court no sentenced, Welye and Lamurde for say the anti-graft commission, no get beta proof ontop their matter.

 Justice Nathan Musa, wey judge the matter, yarn say dem get better proof, ontop the former governor head.

Im say, Ngilari, no follow the state law, before im carry im self go buy moto for commissioners, say the 5 years sentenced, na the one wey im, fit give am.

Musa say, im hope say, this former governor sentenced, go show as lesson to other governors, wey no dey follow law, before dem do, as dem suppose do.

Read wetim im talk

“It is my hope that this conviction and sentence will serve as deterrent to serving governors,” 



Previous
Next Post »

Featured Video