The operatives for the Lagos State Task Force don arrest Awawaa Boys, Kingpin and Co for Dopemu



The operatives for the Lagos State Task Force don arrest Awawaa Boys  these boys bad sote devil no reach.

Their leader Tobi Akinbayo you fit call am  Scorpion and two others, Muyideen Olayinka and Ibrahim Olaniran, police mor this bad gangs for Aluminium Village, Dopemu, Agege, Lagos State.

Chairman for the Lagos State Task Force, SP Olayinka Egbeyemi as him dey parade this gangs say,the bad things wey this boys dey do hmmm no be here sote dey POLICE no fit sleep for night, him still say,the things wey this boys don do plenty well well like rape,armed robbery and dey kill innocent people.and many oda things...

SP Egbeyemi con still dey dom dey hear serious complan about this gang, nayim mek dem go look deep inside wetin dey happon for inside every part of the state, say surveillance unit wey dey inside the  Agency nayim mek the arrest for Aluminium Village, Dopemu, Agege.

Him still call other leaders name wen dey diffrent bad group like Paul a.k.a Bouncng, leader for 'Nokia Group' and Habeeb a.k.a Oluwa of 'Shita Boys' and say dey want dem for killing, raping and robb innocent people, him still say mek public people open eye well well and mek dey report anything wey dem see to  the Task Force.

Tobi Akinbayo wen dey live for 10, Salako Street, Alluminium Village, Dopemu confess say him and him gang don raped, burgled and even kill innocent people wey attack dem anyime dem dey perform their wickedness

Read him talk..

“We also sell Indian helm to commercial bus drivers and area boys around Dopemu and it's environs”, him talk.

The 28 years old boy wey be natve for Kuta Ilegbo inside Abeokuta, Ogun State say dey get gang inside evri where for the state.


Previous
Next Post »

Featured Video