See pics wey won mek me cry; Hundread of people dey die for Bama IDP Camp reach 18-21 a day cause no food



Hmmmmm Hundreds of people wey dey don scatter their house dey die everi day for inside Bama Camp, according to the International Centre For Investigative Report.
 Dey alert health workers On May 5, 2016, say dey need to help some people inside IDP camp FOR Bama, 70 kilometres from Maiduguri, inside Borno State capital.

As dem reach there five women still liadown for ground some dey fine air to breath others dey unconcious.and Three of the women get  children, even the one wey still dey suck breast from her mama and her  brother lay for ground put him head ontop him mama leg.

The only trasportation wey dey get na  handcarts, but befor dey bring the trasport come, won con carry dem go clinic, two of dem don already die, one na the one wen pikin  dey suck breast from.

So dey carry the children of the dead mama give their grandmama, the old grandmama  wey no fit do anything for her daughter as she her self don weak dey look her daughter as she dey die, the small boy con follow die the next day.
Dey leave the woman dead body for outside after 24 hrs befor dey buril her. dey buril her after 24hrs sake of say the man wey one wash the body say no water to take wash and baff demself after the burial.
Health workers, camp officials and security agents say the displaced persons for inside Bama no get food and water and no better medical care say mek dey do something fast fast.
According to the report wey one  local non governmental organisation, NGO, for Bama Community Peace Initiative, BAM-COPI, wey dey work with the Group of Borno State and dem dey under the United Nations High Commission for Refugees, UNHCR, say a day dem dey get  18 to 21 people wey dey die cause of stavation, thirst and no health care and poor hygiene.

Acording to report wyn Ibrahim Mohammed sigh,he talk say.

"Food is cooked on a day in a very poor quality and low ration in all the six designated kitchens (each) with an average population of about 4,000 and above eating virtually once a day,"

For the time wey dey write this report for from May 4 – 20, say dem don buril around 11 children wey dey between 0 – 15 daily

Abeg read the full gist from the month of the people wey talk am

http://icirnigeria.org/inside-bama-idp-camp-21-people-die-daily/

Previous
Next Post »

Featured Video