Kweke O! Amber Rose Don Dey Jealous Blac Chyna



Na if you believe wetin MediaTakeOut talk sha. see how dem take dey talk ham..
.

Dey no fit separate Amber Rose and her former BFF Blac Chyna befor , but now dey no dey too talk like that. And MTO con hear say dem don they hate each other.
So wetin con dey shele between this two babe.if you ask me na who i go ask. We con talk to persin wen dey close with Chyna he con tell us say na one tin dey make kasala dey between the two babe.jealousy. Na so him talk, "Chyna be like Amber small joinbody. but now! wen Chyna don be Kardashian,
her level don high pass Amber. and Amber say No! he no fit happen i no accept that kind thing. hmmmm jealousy."


 Now Amber con dey say Chyna go don thief her business idea.
MediaTakeOut.com persin na him talk this one.Amber say Chyna thief her EMOJI idea. he no even make sense self, Everybody get emogi. Amber think say Chyna won go launch her emoji through Amber company."

We hear say Amber won take LEGAL action against Chyna - for say Chyna won comot from one deal wen dey get together.
So na BUSINESS, or JEALOUSY, or BOTH. Anyone , the two babe no be  PADDY!!! AGAIN!!!

Previous
Next Post »

Featured Video