FG don deploy warships surveillance aircraft to gbege militants



This one dey come from the plenty report wen we don dey get from militants, sote gov deploye surveillance aircrafts go the creeks for Delta State dey look for militant group.

Sodat dey go fit end the gbege bombings for inside Niger Delta region, the Federal Government on Wednesday, May 25, hole meeting with over 50 militant leaders for inside Transcorp Hilton, Abuja.

After the meeting, the government con reached some agreements with the ex-militants.

The Niger Delta Avengers con say no o!!!  Dey no like the meeting, nayim vex catch dem soteeee dey bomb trunkline wen belong to the Nigerian National Petroleum Corporation (NNPC), » on Thursday, May 26, 2016.

Read wetin the militant talk

 “The Niger Delta stakeholder's meeting is an insult to the people of Niger Delta. What we need is a Sovereign State not pipeline contracts.”

People for the area don dey fear sake of the  warships and gun boats wen dey carry come the communities.

According to wetin Vanguard talk, dey say one man wen dey stay For the area wen name na Ayebatari, say

Read wetin him talk

“There is a massive security operation going on in the area. Fighter jets and helicopter gunships have been hovering around the airspace at low level, apparently on surveillance mission. Many of the natives are worried about the development.”



Previous
Next Post »

Featured Video