IPOB don tank Fayose for say him ban grazing for Ekiti



Indigenous People of Biafra (IPOB) don thank Governor of Ekiti State, Ayodele Fayose and Yoruba social cultural group, Afenifere for say dey ban herdsmen from training cattle dem inside the state.

The group, don dey tell governors wen dey South-East, politicians and Ohanaeze Ndigbo say make dey do wetin Fayose and Afenifere do so that grazing no go dey for that area.

the statement wen the Media and Publicity Secretary for IPOB, Mr. Emma Powerful, still say dey arrange to kill one of their member on Monday,wen dem dey remember and honour Biafra Heroes dem wen die during civil war and for protests for Onitsha, Aba, Asaba, Owerri, Port Harcourt and Bayelsa.


“Information wen reach us, tru our intelligence department, say soldiers, police and some Fulani herdsmen wen wear army and police uniforms say dey go deploy them so that  dey go fit execute their plan.

Read wetin dem talk

“We want to use this medium to let the world know that IPOB, under the leadership of Mazi Nnamdi Kanu, is peaceful, intelligent, educated, well informed and determined to pursue the restoration of Biafra through the non-violent means and stipulated international law and nobody can drag us to become violent,” Powerful stated.

Previous
Next Post »

Featured Video